
WIA DIS FOTO COME FROM,AFP
TB Joshua na one of Africa most influential evangelists, with top politicians among im followers.
Wife of Temitope Balogun Joshua, senior pastor of di Synagogue, Church of All Nations (SCOAN) don react to her husband 'sudden' death.
Evelyn Joshua for her reaction wey she post for social media say she no fit question God.
"To lose a loved one is never easy; whether sudden or foreseen e always dey heartbreaking.
"Grief fit wreak havoc on our overall well being. Dat na why e dey important to stay rooted to di Almighty." TB Joshua wife add.
"Only He [referring to God] go fit reduce our heartache and comfort us inside di times," di preacher widow tok.
0 Comments